Pages

Sunday, November 1, 2015

Joke of the day

Na only for Nigeria you fit win Aeroplane by loading N200
MTN Recharge Card.
Very soon Etisalat go say recharge N200 and win a big
ship.
Then Airtel go com follow say, recharge N100 and win
Benin Republic.
Glo, go just kuku say... Recharge N500 and win Nigeria
because their colour na Green.
Na only for Nigeria you go see fish inside"MEATPIE"
Na only for Nigeria we dey count money after we withdraw
am from ATM because we no even trust ATM machines.
Na only for Nigeria PHCN dey say:-
Win a brand new GENERATOR if you pay your light bill (wat
a pity)
Na only for Naija people dey horn for traffic light make e
quick change from Red to Green.
Na only for Nigeria Pharmacy dey sell Coke, Recharge Card,
Chin chin,
Puff puff and beer.
Wetin you no see for Naija, you no fit see am anywhere in d
world...
Trust me.
Na only 4 naija you go find a graduate of Mechanical
Engineering dey do him NYSC 4 Police station.
na only 4 naija you go see one person dey use Bold5, X3,
Ipad2 and Nokia N8 all at once.You be Bill Gates? Abi na
you invent internet?
Na only 4 naija you go see a graduate of law dey work as
generator repairer.
Na only for Naija u go buy coke, dem go say make u no
forget to return d bottle.
Na 4 only Naija, you go see
madman dey control traffic,
people wey their head correct dey
obey...
Na 4 only Naija, you go see advert from native doctor on
how to make quick money.
Na only for Naija u go wish somebody 'happy birthday', he
go answer 'same to u'.
Na 4 Naija obituary poster dem go say "MAMA HAS
RELOCATED"
.. I'm proud of dis my country. Over uniqueness dey worry
us.
God bless Naija.



xirkings

No comments:

Post a Comment